Sunday, April 20, 2008

Something From Our friend Barron Hertzog In California

What's up Alhaji?Na wa oI dey reminisce with my homeboy in Boston and the whole convo' got me LMAO like crazySee, right after high school back in naija, me and my crew no get better to do but clown around and enter all kinds of shenanigans, throway luncheon party everyday, our house be ground zero for neighborhood social malfeasance, if you get shawty wey you won kpansh and you no fit carry am go ya house, no problem, your shawty no see her period, no problem we get tab for Maddy pharmacy (off association in Ilupeju).....make God forgive us all sha.Well, the whole thing come dabaru one day, na one saturday like this, beta no dey, party no dey ra ra. so nothing to do, we just tanda for house gisting say which kain saturday be this? all of a sudden this my friend wey dey boston now con suggest say make we go carry ashawo girls come house take enjoy? first we look am like say abi this bobo don overdose on pure paraga.to cut tory short sha, we agree to the bobo's idea. but we no get enough money to carry one ashawo a piece. anyways, we carry go home with one ashawo short. after small drinks here and there we begin make kpanshing moves, the girls believe say na only 3 guys go fcuk but na 4 of us guys dey..so one of my padis enter the other room as hin no dey fcuk any girl wey no yellow and hin no won fcuk ashawo sef.so we distribute trojanz left and right as action begin ghen ghen ghen, my padi soji leave the one wey hin dey fcuk go take a lil spliff inside the other room, the girl dey wait say where this yeye man, abi hin no sabi fcuk ni?. few mins later hin cut off the light and jump on top the girl begin yansh pah pah pah and all of a sudden the girl say mba mba mba, wetin you dey do? you tink I be any man can fcuck?? so we rush enter the other room go ask say wetin dey happen? the girl dey holla say na different pesin dey fcuck am before and na different pesin dey fcuck am now so hin go charge double...lmaoaccording to her, the pesin wey dey fcuck am before get warm body temp and the pesin wey jump on top am later get cool body temp..na so we begin laff. you see that laff na mistake cos the way the girl dey holla "you tink I be any man can fcuk" non stop you go tink say holy ghost dey her body. very soon all the nosy amebo neighbors go begin perambulate say wetin dey shele. we try cool am down but the baby no dey gree, na one calabar girl like this. so we pull am for side after my friend don explain to me wetin happen. I tell say na the same pesin and that hin just waka go the next room go smoke taffy and the room get AC and na the AC cool hin body down....ha ha ha ha, the girl no gree, even the other girls join in say make we pay dem double and we go see pepper if we no pay kia kia...even Kola the yeye asshole hater next door dey shout say God don catch you.kasala don burst o............we dey there dey pet the useless girls when my papa and his LG chairman friend show up...I look @ the expression on my papa's face and ask myself how bad the shit go get...lol. na the police escort wey my papa friend dey take waka scare the girls comot....we come dey expect make my papa and hin friend tongue lash us, but instead na laff den take us laff, den say the tin foo funny..but we no find am funny at all, not after the the whole neighborhood don sabi wetin happen....so my papa call us say make we go hin friend office, hin say all our shenanigans go stop with immediate effect and dat we dey mess around cos we no get better tin to do. so hin send us go hin friend office say make hin organize work for us. before we know, we dey learn and reading finger prints @ force CID Alagbon...that job na the most boring job ever, everyday we go leave go lunch and go straight home abi go shoot gulf, clown around for polo club abi go chill for our old elementary school after school playground (motor boat club)...na there we dey one day drinking beer during lunch when the same LG chairman enter club with hin padi dem, the bobo look at us, hiss and say you boys no get future ambition..lmao. the yeye job @ alagbon bother us so tay one day we begin debate say we better do something about our lives...before you know we begin discuss how we go enter yankee...the rest na history sha.na wa o
Posted by Omo Eko aka Alhajibabasheri at 2:46 PM 0 comments

Something From Our friend Barron Hertzog In CaliforniaWhat's up Alhaji?Na wa oI dey reminisce with my homeboy in Boston and the whole convo' got me LMAO like crazySee, right after high school back in naija, me and my crew no get better to do but clown around and enter all kinds of shenanigans, throway luncheon party everyday, our house be ground zero for neighborhood social malfeasance, if you get shawty wey you won kpansh and you no fit carry am go ya house, no problem, your shawty no see her period, no problem we get tab for Maddy pharmacy (off association in Ilupeju).....make God forgive us all sha.Well, the whole thing come dabaru one day, na one saturday like this, beta no dey, party no dey ra ra. so nothing to do, we just tanda for house gisting say which kain saturday be this? all of a sudden this my friend wey dey boston now con suggest say make we go carry ashawo girls come house take enjoy? first we look am like say abi this bobo don overdose on pure paraga.to cut tory short sha, we agree to the bobo's idea. but we no get enough money to carry one ashawo a piece. anyways, we carry go home with one ashawo short. after small drinks here and there we begin make kpanshing moves, the girls believe say na only 3 guys go fcuk but na 4 of us guys dey..so one of my padis enter the other room as hin no dey fcuk any girl wey no yellow and hin no won fcuk ashawo sef.so we distribute trojanz left and right as action begin ghen ghen ghen, my padi soji leave the one wey hin dey fcuk go take a lil spliff inside the other room, the girl dey wait say where this yeye man, abi hin no sabi fcuk ni?. few mins later hin cut off the light and jump on top the girl begin yansh pah pah pah and all of a sudden the girl say mba mba mba, wetin you dey do? you tink I be any man can fcuck?? so we rush enter the other room go ask say wetin dey happen? the girl dey holla say na different pesin dey fcuck am before and na different pesin dey fcuck am now so hin go charge double...lmaoaccording to her, the pesin wey dey fcuck am before get warm body temp and the pesin wey jump on top am later get cool body temp..na so we begin laff. you see that laff na mistake cos the way the girl dey holla "you tink I be any man can fcuk" non stop you go tink say holy ghost dey her body. very soon all the nosy amebo neighbors go begin perambulate say wetin dey shele. we try cool am down but the baby no dey gree, na one calabar girl like this. so we pull am for side after my friend don explain to me wetin happen. I tell say na the same pesin and that hin just waka go the next room go smoke taffy and the room get AC and na the AC cool hin body down....ha ha ha ha, the girl no gree, even the other girls join in say make we pay dem double and we go see pepper if we no pay kia kia...even Kola the yeye asshole hater next door dey shout say God don catch you.kasala don burst o............we dey there dey pet the useless girls when my papa and his LG chairman friend show up...I look @ the expression on my papa's face and ask myself how bad the shit go get...lol. na the police escort wey my papa friend dey take waka scare the girls comot....we come dey expect make my papa and hin friend tongue lash us, but instead na laff den take us laff, den say the tin foo funny..but we no find am funny at all, not after the the whole neighborhood don sabi wetin happen....so my papa call us say make we go hin friend office, hin say all our shenanigans go stop with immediate effect and dat we dey mess around cos we no get better tin to do. so hin send us go hin friend office say make hin organize work for us. before we know, we dey learn and reading finger prints @ force CID Alagbon...that job na the most boring job ever, everyday we go leave go lunch and go straight home abi go shoot gulf, clown around for polo club abi go chill for our old elementary school after school playground (motor boat club)...na there we dey one day drinking beer during lunch when the same LG chairman enter club with hin padi dem, the bobo look at us, hiss and say you boys no get future ambition..lmao. the yeye job @ alagbon bother us so tay one day we begin debate say we better do something about our lives...before you know we begin discuss how we go enter yankee...the rest na history sha.na wa o

No comments: